UNA WELCOME

UNA WELCOME .

My Contiri pipol, I dey trowey salut o. Na true bukuru pipol dey yan sey if the purpose of something is not known, abuse is inevitable.

Meaning sey if persin no Sabi wetin dey, e possible sey e go dey talk anyhow, dey  yarn puan, and dey match line! So dia for, e go beta maik contiri pipol Sabi wetin dis SPEAKER ( OSHOBEY ) tanda for. Una wellemly welcome.

No be lie sey we all get Speakers for our   difren difren State House of Assembly, even sef for the contiri kpakpa we get Senate Presido plus including Speaker for House of Representatives.

Good and fine, dem sef get members, and true true "Dem dey represent dem pipol well well" no be lie, dem dey try, after all, den no dey try pass try. Ok wetin kon be the work of dis SPEAKER na?

Yes, dis SPEAKER ( OSHOBEY ) na the ordinary pipol speaker, speaker for the common Man wey dey one corner of one shikiny village, town plus including City. Speaker for Wetin dem wey go bukuru dey call Downtrodden.

Speaker of the common tabi na ordinary citizens of the Federal Republic of Naija.

Like I dey talk before, no be sey all our state House of Assembly Speakers plus including Senate Presido join with Speaker for House of Representatives no dey try o and all the Representatives members wey comot from diften difren Constituencies, But dis SPEAKER OSHOBEY dey Represent dia CONSEQUENCES.

E be like sey I dey see some pipol dey laff.

 Yes, the consequences of wetin di comon man dey surfer from most of the tori wey dem dey dia dey talk sometime for dem own pocket. Nbanu, no be for me and you o.


The SPEAKER ( OSHOBEY ) dey helep im ordinary pipol dey talk wetin den no get opportunity to tell our Big Oga dem. The SPEAKER ( OSHOBEY ) na the pipol' s Speaker.

 E dey yarn the Mata as e be. Ehn, before I forget, somebody go dey ask wetin be OSHOBEY? 

No be bad thing if you ask jare, OSHOBEY na Crowd of pipol. OSHOBEY no be one pesin o. If I shout OSHOBEY and only me answer hey!, E no maik sense, but If i shout OSHOBEY! and all of us answer heeeeeeeeey!

 How una seeam? Good abi ? Na Unity be our power. One pesin no dey hala OSHOBEY. OSHOBEY na together tinz.

Wetin dey be sey, na together we go gada maik Naija beta for all of us. Na wetin dey for the Speaker OSHOBEY podcast plus including other platforms wey OSHOBEY go dey carry reach our contiri pipol be dis.

 No forget to dey reach the Speaker OSHOBEY with all our social media platforms.

I salut all of una o .


OSHOBEY! Haba, maik una answer na,

Comments