AEDC KOGI REGION GIVE KOGI STATE GOFMENT PALLIATIVE SOPOT
















LAST LAST, AEDC NO DEY CARRY LAST




No be small thing Abuja Electricity Distribution Company( AEDC) do for Kogi State Government House on the 28 of April 2020. The company sey at all at all den no go fit carry last for the mata wey dey ground so.So dia for, as part of dem contribution to see sey dem helep government to provide for dem pipol for dis time wey contiri pipol dey hear nwin sake of the yamayama of Corona Virus, plus including sey na part of wetin Bukuru pipol dey Call Corporate Social Responsibility, den still wan let contiri pipol and the government of Kogi State know sey den stand with dem for dis time of gbeghe wey dis Corona Virus kon put for ground.

At all at all, the Ogbonge AEDC Kogi Region bring 400 bags of 4.5kg of Rice, 38 bags of 50kg Beans, 60 bags of 10kg Semovita, 50 gallons of 20litres Red Oil, 5 cartons wey contain 50 bottles of hand sanitizers plus including 24bags of 12.5kg of Garri.
Wen e dey talk, di General Manager, Kogi Region of AEDC, Egnr. Abdumutalib Mohammed kon let kogi government know sey den no blind to wetin dey go on for the Contiri sake of wetin the Corona virus dey cus and na bicus of the kain palava of hungry wey the Corona virus kon put for ground naim maik AEDC bring wetin den carry come to come help Kogi State government as dem own contribution. E sey the company don still carry things like dis go other areas to helep dem since dis Coroviru Palava enter town. The wan wey e talk wen really sweet Kogites body na wen e sey den dey do plan to put Kogi for the 33KVA Line wey go maik kogi state enjoy beta light. Engr Abdumutalib mohammed kon salute Kogi state Government for everything wey den dey do for AEDC work to taik dey waka siwiri werere.

By the time im dey talk, the Oga wey tanda for Governor for the occasion, Rtr Navy Commodore Jerry Omadara kon salute AEDC management for wetin den carry come taik helep kogi pipol for dis season wey Corona Virus taik dey gbeghe every where so. E let the Aedc management know sey Kogi state government dey do every thing to maik sure sey the yamayama no enter kogi. E sey before anything happen, Kogi state don  begin dey use jingles with plenty local language plus English and pidgin to dey tell im pipol of the corona virua and how den go taik dey keep den body from the yamayama Corona virus. E still maik the team of AEDC know sey even doug sey the yamayama never enter kogi, den don prepare Isolation centres for ground and den get numbers wey den don give dem piopl to call  in case dem see any persin or if den get any sign of the korona virus.

The Hon. Commissioner for Information and communication, Envg. Kinsley Fawon naim kon finally do the talk talk of salute before every body carry waka comot the occasion wey AEDC for kon  give dem COVID-19 Palliative . Government oga dem wey dey the occasion kon be Environment commissioner,  Hon Adewale Omofaiye, Envg. Kingsley Fawon, DG Protocol, Government House plus including staff of Government House.

Comments