AS YOU DON BE AG.RECTOR SO, OSHOBEY SEY


Ag Rector Sir,

Na common thin and na good thin too to happy with any persIn wey beta thin happen to. Da na why wen the tori comot outside sey den don maik Dr. Usman Ogbo as Ag Rector for Kogi State Polytechnic, no be small happiness from im family, friends plus including im enemies even though sey some go pretend but den no get choice na.Like I dey talk before, maik we happy with dem wey dey happy and maik we no forget too sey, we wey dey happy go ready to tanda with the person wey we dey happy with for rain and for sun. na how den taik dey sabi beta friend be dat.
Den no dey argue the mata again sey noting wey dey permanent, even wen den sey you be permanent secretary, you no fit dey dia forever o. So dia for maik we all wey dey happy with our brother and friend know sey even as e tanda dia today as Ag Rector so, and by the grace of God our Ogbonge Governor kon permanent im appointment, one day e go still comot dia for another persin, abi persin know dey dia before im enter as Ag Rector?
All wetin Oshobey the Speaker dey try talk hear be sey, maik you wey dey happy with your friend tabi na your brother do every thing to maik sure sey im succeed for im new post. Thank God for technology, difren ways naim don dey to taik dey katapot massege dey give pipol dis days. Even if you get your own plan to get some favour from am in the future, e go beta maik you helep the Man tanda gidigba first before anything. After all, if e beta for hunter, e go beta for im bag.
Our Papa dem naim talk sey na cloth wey you carry go river, naim river dey helep you wash o. So dia for, na wen the Ag Rector sef go dey open to advise naim all dis tori go work. If im decide to sey, I beg maik una carry una wahala and wayo go front, I no get time for una, e no get wetin anybody go fit do. But I get the believe say Dr. Usman Ogbo no go behave like dat. I talk lie?
Ag Rector Sir, I beg no forget to remember sey na Academic environment you comot from get dis ogbonge assignment from His Excellency. You no be new person for education mata for the State and the contiri kpakpa even though sey some people dey talk sey you no ripe to dey wia you dey so. No look any person as your enemy o, for dis world everybody get right to im own opinion o. You too as you dey there today no go fit swear sey for your life you never do wetin you dey hear other dey do now. The truth be sey some pipol dey forget sey for dis World wey we all dey so, grace dey play very important part of our life and dat one dey the Hand of the Almighty God. E no dey the hand of any mortal Man. And you wey dey enjoy grace, no use your own hand taik trowey your unmerited grace o. Know sey every good gift comot from Baba God and e no dey give you anything without any reason. You must use the opportunity beta pipol life, Community and change anything wey you meet for ground for beta.
Oga Governor, you see plenty other pipol before you pick Dr. Usman Ogbo maik e helep you work as the Ag Rector of Kogi State Polytechnic, you do well. But e never finish for there o, you go helep am too with all the things wey im go take do the work well for you. You see, Oga gofnor, wen you give am everything to work and e kon fail, God forbid, you go get plenty reason to use beta “ KOBOKO” taik flog am well well. Again, e no good sey maik the tori go be like person wey go buy goat for market, the rope still dey di hand of the owner of the Goat. I trust sey our Ogbonge Gofnor go do everything to maik the Job wey e give im Personal Person dey go smooth, siwiriwerere.
Finaly, AG Rector Sir, the whole mata dey your hand now o. Before, den dey call Kogi Poly glorified Secondary school, until one Professor Ajibero come try im best, others come after Prof. Ajibero before you take over so. Na Commander Ebenezer Obey sing sey, Do your best and live the rest. But maik sure sey the best wey you go do so, na wetin posterity go taik remember you. Work very closely with your staff and Management team, comot ear from dem sey dem sey, No forget management by going around, remember sey na person give you job, relate with am and above all, FEAR GOD.


Comments