WELCOME 2021, MY LEVU DON CHANGE O
Hmmmm nor be
small ting o. So na me and you dey like dis gidigba dey look 2021 calendar kikiki with awa
two nakedness eyes so! Baba God we tank you o, if not be Baba God ehn, Wetin
2020 plan enh, no be here o!
Oya maik we
check am, first na corona virus, we never comot from dat one palava, see flood
everi wia, before we sey jack, see #Endsars, before you ask wetin dey hapun kon
see di proper palava wey be Palliative! Na my mouth una wan hear sey fish wear
rain coat abi, for all dis one wey dey hapun so, na so human being dey delete
dey go thy kingdom come. Hmmmm, no be
small ting sha, we tank God sey me and you fit still see 2021 wit Kakaraka
body.
Me, Oga
vendor, I go tank baba God well well for dis Keresimesi wey pass so o, infact, I
no go lie, na dis one be di first time wey I don enjoy my keresimesi since wen I
sabi my sef as Man.
Una go
remember di tori of the Honorable wey come my Newspaper stand with Hilux, yes,
na dat very day my joliment for my keresimesi start. After di commissioner give
me part of di money wey I go taik dey supply for di state, na so e give me 5k
maik I taik hold my sef for di Xmas jolimento.
Later dat
day as e turk sey maik I bring my proposal come im office, and as e be sey I never
write proposal before and I nor know how den dey do dis kain proposal, na so I sofly
sofly go me Baba old vendor from Lagos. Maik God bless Baba o.
My pipol,
experience good o, as I explain give Baba old Vendor how commissioner for
information and communications come my Vendor Stand come tell me sey as from
2021 na me go dey supply all gofment office, baba shake im head kon tell me sey
my days of hand to mouth chop chop don pass. I sey Amen.
By di time
wey baba finish di proposal, na dia I know sey you nor go fit taik persin
experience from am evun if you drive di persin from work. True true, Baba old
vendor sabi di work.
As I enter di
new state secretariat wey commissioner office dey, kon see as my customers wey
sabi me for my newspaper stand dey hail me like sey I be Baba for Aso Rock. As I
tell dem sey na commissioner for informate naim I kon see, na me kon dey choose
who wan carri me go im office. Everi body naim wan carri me go dia but I kon
use sense ask dem sey wia be im office? Den tell me sey na di top top floor. Na
so I trace am go.
As
commissioner see me, e shake head give me im hand shake den ask for di
proposal. As e dey read am e dey smile, na wen e finish e kon ask me di
question wey go maik me wan go evening school now. E sey maik I talk true sey
na me write di proposal? As den don teach us for church sey nothing like small
lie, sey lie na lie, I kukuma tell sey na one old retired vendor write am for
me.
Again, commissioner
look me shake head kon sey maik I know worry maik I drop my account number with
im secretary as I dey comot im office. E sey im like wetin e see for my
proposal and maik I nor fail to dey supply all di pipol wey im tell me sey maik
I dey supply. E sey maik i nor play wayo sake of sey den go dey taik record of
wetin I dey supply o. I tell am ok no wahala.
As I dey
comot im office, e give me Ten thousand Naira and tell one of im boy maik dem
give me 10kg bag of rice.
Na so I taik
tell my sef sey dis keresimesi I must go village go doam. I go village with my
wife, Tobore later comot from school kon join us for village. We flez village
last year no be small ting. Money dey and as God don change my level, I pay all
my family meeting money and evun host friends. You wan try Oshobey.
I don come
back to base. Bizness don start but as e be with my standby supply, my level
don change o.
Welcome to
my Turnaround Era, 2021
Maik we see again on Saturday.
Go oshobeythespeaker.blogspot.com
for more tori

Nice one chief
ReplyDeleteThank you so much for being there.
DeleteDomo sir, me I wan enjoy from d 10kg and #10 Bros.
ReplyDeleteHahahahah!!! Happy new year sir.
You too much. You go enjoy with me. Thanks.
DeleteIt only be God. His mercies endured forever.
ReplyDeleteWe bless God.
DeleteIt can only be God. His mercies endured forever.
ReplyDeleteWe thank God. I appreciate.
Delete