MAIK WE DEY SOFLY O




I dey salute my pipol for dis period wey tinz kon dey zigizaga for our contiri. Hmm, we never see sometin like dis before o, but our hope be sey, e no get any ting wey pass Baba God.

Dis coronavirus palava don over every contiri and na join body of every body brain naim we go taik find solution to the mata. Maik we comot the tori of na you carry am come, na you no quick tell us and other plenty game of blames.

As e be so, no time to check who to blame for the whole palava, na how to see how to vamuse dis Kolo Coronavirus naim dey ground now. Maik we all dey sofly sofly dey talk so dat wahala of contiri to contiri no go happen for dis one wey dey ground so.
Speaker no talk pass dis one o.

Comments