LADAN PLAZA SHOP OWNERS SET GOOD EXAMPLE
E dey
possible sey some pipol go call wetin dem do as” eye service”. While other
pipol
go sey, hmmmm, dis na the type of pipol wey we want for dis our kind of society.Wetin
den do on April 30, 2020 na wetin many Nigeria Pipol go see as surprise sake of the kind of society wey we kon find oursef. Wetin happen sef?
April 30
2020, Oshobey carry waka dey do dem waka and see function, Naim den see some
pipol dey dig and dey pack plenty dirty dey commot from gutter. Wetin really
carry our eye go dia be sey, we notice sey dis no be di gofment workers or
contract workers wey we sabi sey na dem dey do dis kain of work for the state. Na
wen we ask, naim den tell us sey na dem wey get shop for Ladan Plaza wey dey
before Ganaja junction for Lokoja, naim go carry daily workers come dig and
pack all the dirty wey don block di gutter sotey water no see place pass but to
enter road and begin dey spoil de road. Den sey the water don begin dey cut the
corner of de road and if den no doam quick, e go dabaru the road and e go dey
disturb customers wey wan kon the Plaza kon buy things from dem.
Mr. Onyema
Nwanchukwu wey dey sell Rugs and Furniture na shop owner for Ladan Plaza and
Mr. Joseph Umechukwu wey dey sell Building materials and na neighbor to Ladan
plaza believe sey gofment no go fit do every thing. According to dem, den sey den
no fit wait for gofment to come do the work, but den believe sey if den doam na
helep den dey helep gofment. Mr. Samson wey dey corner of ladan plaza dey do im
small business talk sey maik contiri pipol dey helep gofment dey do work for
both dem house and for the place wey den dey do dem market. Joseph Umechukwu
sey maik gofment do every thing to dey tell contiri pipol maik dem no dey
trowey dem dirty for gutter as naim dey block the gutter maik water no dey see
place pass.
The Kogi
State Commissioner for Environment , Hon. Victor Adewale Omofaiye thank the
Ladan Plaza shop owners well well for the beta work wey den do to clear dirty
from the gutter wey dey the front of dem plaza and use the opportunity to beg
other pipol maik dem take example from Ladan Plaza shop owners. E sey if we get
pipol like dis plenty for Kogi, den no go dey shout too much before dem go come
clean dem yard during environmental sanitation. E promise dem sey the gofment
of Alh. Yahaya Bello go do everything to maik sure sey business pipol get clean
and safe environment for dem business to waka siwiri werere.
Comments
Post a Comment