WE NO DEY WAIT FOR GOFMENT DEY DO WETIN WE FIT DO


LADAN PLAZA SHOP OWNERS SET GOOD EXAMPLE

E dey possible sey some pipol go call wetin dem do as” eye service”. While other pipol
go sey, hmmmm, dis na the type of pipol wey we want for dis our kind of society.Wetin







den do on April 30, 2020 na wetin many Nigeria Pipol go see as surprise sake of the kind of society wey we kon find oursef. Wetin happen sef?

April 30 2020, Oshobey carry waka dey do dem waka and see function, Naim den see some pipol dey dig and dey pack plenty dirty dey commot from gutter. Wetin really carry our eye go dia be sey, we notice sey dis no be di gofment workers or contract workers wey we sabi sey na dem dey do dis kain of work for the state. Na wen we ask, naim den tell us sey na dem wey get shop for Ladan Plaza wey dey before Ganaja junction for Lokoja, naim go carry daily workers come dig and pack all the dirty wey don block di gutter sotey water no see place pass but to enter road and begin dey spoil de road. Den sey the water don begin dey cut the corner of de road and if den no doam quick, e go dabaru the road and e go dey disturb customers wey wan kon the Plaza kon buy things from dem.

Mr. Onyema Nwanchukwu wey dey sell Rugs and Furniture na shop owner for Ladan Plaza and Mr. Joseph Umechukwu wey dey sell Building materials and na neighbor to Ladan plaza believe sey gofment no go fit do every thing. According to dem, den sey den no fit wait for gofment to come do the work, but den believe sey if den doam na helep den dey helep gofment. Mr. Samson wey dey corner of ladan plaza dey do im small business talk sey maik contiri pipol dey helep gofment dey do work for both dem house and for the place wey den dey do dem market. Joseph Umechukwu sey maik gofment do every thing to dey tell contiri pipol maik dem no dey trowey dem dirty for gutter as naim dey block the gutter maik water no dey see place pass.

The Kogi State Commissioner for Environment , Hon. Victor Adewale Omofaiye thank the Ladan Plaza shop owners well well for the beta work wey den do to clear dirty from the gutter wey dey the front of dem plaza and use the opportunity to beg other pipol maik dem take example from Ladan Plaza shop owners. E sey if we get pipol like dis plenty for Kogi, den no go dey shout too much before dem go come clean dem yard during environmental sanitation. E promise dem sey the gofment of Alh. Yahaya Bello go do everything to maik sure sey business pipol get clean and safe environment for dem business to waka siwiri werere.  

  




Comments