MAIK GOFMENT CARRI CSO PLUS INCLUDING NGO JOIN BODI TO SHARE PALLIATIVE O!
MAIK GOFMENT
CARRI CSO PLUS NGO JOIN BODI TO SHARE PALLIATIVE O
Since the
yamayama of Corona Virus comot from China enter difren contiri wey dey the
world, no be small palava e don carrI put for the World. Apart from the kaput
wey the yamayama don kaput pipol for plenty contiri for the world, e don dabaru
the economy of plenty contiri . Sake of dis, We dey see am sey na real hungry
go follow after dis palava of Corona Virus.
One of the
ways wey den talk sey den go taik dey check race wey dis Corona virus taik dey
enter contiris, na wen den tell pipol to dey stay inside dem house, maik dem dey
always dey wash dem hands, dey use hand Sanitizer, dey observe social distance,
dat is maik contiri pipol dey give chance of two metres wen den dey public
place plus maik den dey use face mask. The ogbonge one for the whole mata na
the one wey government taik talk sey maik every body stay for dem house. Hmm,
dis one, contiri pipol no dey find am easy o, even though sey na wetin WHO talk
sey e go helep for the mata of the Corona Virus to vamuse. But gofment sey den
go try dem best to dey find some chop chop for contiri pipol to taik dey hold
body as most of dem no get time to comot go out for dem bisuness.
Plenty
complain don dey for ground concerning wetin gofment dey give contiri pipol
taik dey hold body. Some sey wetin den dey give no even reach small pikin chop
how much more adults and family. Some even dey complain sey the way wey den
taik dey share the things get plenty wuruwuru, sotey some pipol no dey see the
things for eye sef. Dis one kon maik the whole mata of the sharing of gofment
Palliative get plenty coma.
Mr.
Nathaniel Abaniwo wey be the Oga of Rehoboth Community Advancement Initiative,
na Non Governmental Organization NGO for Kogi state, E sey im salute gofment
for the mind wey den taik even sey den go find some thing to helep contiri
pipol wey den sey maik den sidon for House for the Lockdown. But im go advice
gofment maik den carry NGO’s join body wen den wan begin share all dis
Pallliatives to contiri pipol sake of sey, most of the NGO don dey work with communities and den don sabi most of the pipol
wey really need all dis things wey gofment wan share so.
Abaniwo sey im really
salute the Kogi state gofment as den put one of dem member of the Civil Society
Organization join body for the Kogi state covid-19 Squadron committee. E sey maik gofment try to always dey listen to wetin dat dem
member wey dey the committee go dey tell dem, as e go helep dem wen the time
don reach to share the Covid -19 palliative to contiri pipol for Kogi State.
No be wetin
den dey hide again of the many tori wey no good for ear about how den dey share
gofment palliative and plenty pipol no dey see am for eye how much more sey den
get am. Some pipol wey even get sef dey sey e for beta maik den no even come
share as the things wey den share no good for eye at all.
The koko of
the mata now be sey, maik gofment carri the civil society organization CSO,
plus including NGO join bodi wen the time don reach to share the Kogi state
Covid-19 palliatives. Even though sey we sabi sey no mata wetin den do, pipol
must still complain, but with proper planning join with the right pipol to use
for the sharing, the complain no go too much and e go give beta name to the
present administration and pass mark to the Kogi state Covid-19 Squadron
committee as dem share the palliatives for kogites.
Comments
Post a Comment