#ENDSARS, NA WIA YOU DEY FOR DI MATA

E nor dey surprise me again wen I dey hia some contiri pipol dey pray sey maik di year 2020 jejeje waka im own go.

Oya, maik una helep me check, dis year naim we wake up kon see Coronavirus alias Covid-19, we never comot from dat one finish, see us see Flood, befor we sey Jack Robison, see #Endsars abi na di kilikili of pipol wey dey carry palliative we wan talk!

Una dey see all di palava, but if you dey follow dey read dis tori, I happy for you sake of sey you dey among di pipol wey go see di end of dis year in Jesus name.

Me, Oga Vendor, I no go lie sey upon all di katakata plus including di gbeghe wey dey dis year, Baba God no forget to give me dis Vendor business to do. You nko?

Dis week wey pass so na wetin I go pray maik  i no see again for my life. See me wey just start my Vendor business naim #Endsars wan dabaru bisness for ground for.

 Di #Endsars protesters dey one side dey do den own jejeje, di ones wey later come sey dem dey find palliative dey one corner dey do dem own. Sotey, we get Endsars Prostester, Hoodlums and thugs all for one land. Hmmm, Oghene biko.

 Na for wia man pikin for wan kon go arrange Newspapers begin sell wen everi wia dey catch fire.  Na so di #Endsars taik spoil Market o. But di one wey pain me pass na Okoro broda in- law wey stray bullet meet and delete for nia Adankolo market .

To maik mata worse be sey wen den dey look for hospital to rush the boy go, kon see Wahala, di only Federal Medical Centre wey dey lokoja den lock dem gate and before den do anything Okoro brother in-law die.Na di contiri wey we dey be dat o.

Wen I manage open market for my Oga Vendor Stand, kon hia tori, hia argument plus including analysis. Papermentarians gada informate no be small. See dem see newspapers for dem front o but na dem own dem sey, dem sey, naim den go begin talk.

Na Mufun naim first find trouble dat day wen e sey im dey happy sey den dey fire pipol wey dey go break warehouse dey carry palliative. According to Mufun, im sey na dem be di only pipol wey dey hungry?

Shegbe nialy wan slap Mufun for dia if no be pipol wey hold am. im sey why Gofment nor dey give pipol wetin be dia own, sotey some of di palliative don dey spoil.some wan expire.

Me, Oga Vendor still chuk mouth for di tori kon tell dem sey if nor be dis #Endsars now, so na so food wey pipol dey hungry dey find for jos dey spoil dia. You, wetin be your own.

Shehu sey di only thing wey maik am dey happy be sey Allah don maik pipol see sey Baba Buhari na beta persin if not for all di state Gofnors  wey nor want maik poor pipol chop.

As Shehu talk dat word, kon see how other papermentarians face am with bad mouth  like sey naim den dey wait for since to talk so dat dem go trowey all dem vex for im body. Kon see insult. I nor need to tell you how di mata end dat day.

Dis year 2020 nor easy but like I talk before, Baba God go maik me and you see di end. 2020 nor go see awa end in Jesus Name.

Nor do wetin you no go fit tell me o.

Maik we see on Wednesday.

 

Comments