NA DIS BABA BUHARI SPEECH WAN KURS KASALA O

I nor know who go helep me tell my nebor wife sey dem sey, dem sey family nor dey get true tori. See me o, Oga vendor wey go comot for house before 6 O clock in di momo to come back my house na after 5 to 6pm naim one woman go come carri aproko mata come begin disturb Mama Tobore.

E go start am from how area boys and girls sey den wan go join di Endsars mata and how im beg dem to sidon for house, how dem tell am sey every wia dey cash fire and how dis one hapun and  how dat one hapun and na your house you sidon.

I don tell Mama Tobore sey as I dey land from work, as I baff finish, na food and as  I  lego for bed na sleep be dat. My pipol, na wen I enter di work I know sey no be joke o. For di vendor stand, nor be small orishirishi pipol you dey see dia o.

 Sometime di argument go hot sotey e go wan turn to fight and na me go begin settle dem. Sometime na so I go dey shout maik dem drop my papers. You go see about five pipol go carry your paper dey read as if sey den dey prepare for Exam. And nor be sey dem wan buy am o. I don talk tire.

Na sake of all dis stress for di work naim maik me tell my wife sey as I dey land house na baff and chop. But as if sey den send my nebor wife come, na dat time gon e go take come engage my wife for tori. Osalobua! Na wish kain winch kon be dis. Una go tell me wetin I go do o.

For di Newspapers stand today, no be small tori. Everi tori center for Baba Buhari Speech. One okada Man wey im sey na since seven years naim e don dey ride okada after e don get HND talk sey Baba no try sam sam, e sey Baba nor just talk about pipol pikin wey die for lekki Toll gate. James wey sey im be Teacher kon ask di okada Man sey e hia of any Papa or Mama wey cry come out since dat Tuesday sey im pikin die for LEKKI?

Come see as everybody wey dey di stand wan eat di man raw. Den kon ask am sey maik e explain wetin e mean with wetin e talk so. Okoro sef shook mouth for di mata sey na sake of sey na di curfew wey den put for ground naim make mani pipol neva come out to come report dem own tori. E sey dem sey na over 30 pipol naim di sojas dem kill for dat Lekki Toll gate.

As if sey di Teacher dey my mind, e kon ask Okoro sey weda im dey dia. Immediately, na so about seven Papermentarians join dem mouth together ask di Teacher sey im too dey dia. Di tori don begin dey hot naim I shout sey maik dem Calm down, calm down. Like play like play I don become di Speaker of the Peoples Papermentarian Assembly o.

 

 By God’s grace we go see again on Tuesday.

 

Comments