NA GOD SEND MUFUN COME

Na wao, since wen I go church wey Baba God tell me sey maik I be Newspaper Vendor, na how I go taik start di business naim dey my mind. As I hia sey problem wey  persin shia na quarter solve, na so I call two of my friends- Shehu and Okoro come my house for Ganaja Junction. See me o, immediately I tell dis two pipol my tori about how God taik tell me to enter vendor business, na so dem begin laff sotey I kon begin shame for myself.

 As dem laff finish, na shehu naim first talk. Im sey as my friend e go advise me to forget di voice wey I dey hia sake of sey I dey dream. E sey I go church go sleep. Okoro sey maik I no worry sey im go tell me wetin I go dey do. Wen I ask am sey wetin I fit do as im too follow shehu dey laff me, e sey maik I dey dream like Joseph for Bible dey tell pipol wetin den fit do as God dey tell me things to do so.

I enter my room go think wetin dis my friends dem talk, as I dey think na so I dey hia di voice again. Before I comot from room enter palour dis two friends don go. As I dey still dey tink wetin den talk, my Tecno fone ring. I look am na Mufun, I be no wan pick am thinking sey na laff im too go still kon laff me wen I tell am wetin I tell shehu and Okoro, but I gada power answer kon tell am sey I dey house. Before spit wey I spit for ground dry see Mufun for my house. I tell Mufun all wetin hapun between me, okoro and shehu, na so Mufun kon tell me sey maik I no mind dem sey na bad belle dey worry dem. E sey im believe sey na God talk to me so. I kon tell sey na how I go taik start di business naim be di koko.

My pipol, e be like sey na Mufun God send come like dat small evangelist girl dis time. Mufun carry me go meet one old Baba wey im sey e don do di work many years for Lagos before e come home for Lakoja. Di Baba tell us many things about newspaper vendor. E sey money nor too dey inside o but at least you nor go poor. E even tell us sey like sey im wan do di business for lokoja, na dat NTA Roundabout  wey get Graphic Newspaper dia and NUJ nor far from dia go be im vendor stand. I no forget dat point. I swallow spit.

Baba still tell me many things to do to take start. I nor need any proof again from God sey na Newspaper Vendor I go do. Na NTA roundabout go be my Vendor Stand for now. I dey start business next week for NTA Roundabout and I believe sey you go kon buy your Newspapers dia. Come I dey wait for you.

See you on Saturday.

Comments