NA MY FIRST
DAY WITH MY PIPOL. THE PAPERMENTARIANS
Maik una dey
see me o. After I don tell una last week about how My wife, Mama Tobore taik
helep me with Money to taik start my Newspaper Vendor business, na so I carry
my own leg go meet Okoro again to tell am sey by the grace of God na for my
vendor stand naim e go dey come dey see me now o.
As if sey
dem send am come skata all my plan, Okoro sey maik I no use umbrella as many
newspaper vendor dey do o, e sey maik I try do cubicle with kpako. E sey maik I
dey difren from other vendors wey dey town.
I know sey na beta thing Okoro dey talk sha
but again wia di money dey. If no be my wife sef I no for even dey think sey I for
fit start. I be don dey tink wetin Okoro talk to call carpenter to begin do di
cubicle until I remember dat day wey I enter church and the Pastor dey talk sey
many pipol if den wan do business, den go wan get big money first, but before
you know den no go fit start again.
The Pastor
sey den no sabi sey you go start with wetin you get for hand, start from wia
you dey and remember to bring Baba God inside di business and as you follow do
your business with the fia of Baba God, na so your business go waka siwiri
werere.
My contiri
Pipol, as I remember all dis words wey di Pastor preach dat day for church, na
so I fashi everything wey Okoro tell me, straight I go buy dat Big Umbrella wey
be ike di one wey dem taik dey cover some of dis Northern Emirs. I tell
carpenter to do one big table for me and my chair too.
Today now,
see me for my Vendor Stand and to maik the tori sweet for me all di papers
carry dis #Endsars tori. Come see as my stand full with pipol wey wan hia di
latest tori about dis Katakata wey dis #Endsars kon carry enter for awa obodo
contiri. Coro never comot finish o. wetin be dis sef!
Nor be small
orishirishi pipol full my Newspaper stand dis first day wey I start my Vendor
business o. Even sef my friends Ojochegbe, Okoro, Shehu, Mufun and my area brother
Onovughe aka Onos Baba all dey dia to
give me solidarity as I open.
Come see argument
for dia o. Sometimes, if you see di kind argument for dia ehn, you go dey tink
sey na National Assembly you dey o. Di pipol wey dey support end sars vesus
pipol wey sey maik Sars continue. As di tori dey hot dey go, I go hia motor
horn pim…pim” you get The Herald”, before I go sey maik I carri am go give di
driver wey ask for am, somebody don helep me comot am give di person and
collect money for me. Na how di love dey for dia be dat.
Although Baba
don tell me sey I go dey meet difren kind of pipol for my stand o, I go confess
sey me, Oshobey need to get patience for dis business with dis “Papermentarians”
sake of sey most of dem na free reader dem be.
Nor do nor
do, I don start my Newspaper vendor business and to the glory of God, my first
day sweet. Remember, start from wia you dey, start with wetin dey your hand and
with wetin you get.
Maik we see
on Sarturday.

Comments
Post a Comment