UNA HELEP ME
SALUTE MAMA TOBORE O
Since wen my
wife, Mama Tobore come from travu, im way just change once. Make una come see di
way wey e come dey taik dey love me like sey we just marry new. Hmm, something
dey tell me sey maik I dey careful for dis kain love o. But as a sharp Warri
Man, I do my small investigate.
Fia Women o,
I nor know sey before Mama Tobore travu go Warri go meet im younger sister wey
born, e don put one of my nebor wife maik e dey Monitor all my waka. Na dat
Aproko woman naim kon tell my wife all di things wey dey go on for my house and
my life before she come back. Imagine o, my wife dey ask me how service be for
di church wey I go, I first tink sey na the Bible wey den give me as first
timer wey she see naim maik am know sey I go church, na wen she begin dey down
load everything wey hapun from wen I go church tili wen Mufun carry me go see Baba naim I know sey I need to fia Women aproko.
Anyway, to
cut a short tori long, she salute me well well and promise me sey im go join
body with me for my Vendor Business to work. E sey wetin dey maik me dey tink
sey im be gbagbati wife na sake of sey e nor dey happy to see sey im Husband go waik up for morning, chop den go
sidon dey play draft. E nor dey think of im Pikin, Wife plus including
family members! But e sey as I don change so and even dey go church join, im happy
well well.According to am, e sey im belle na sugar industry now. Oghene Ose!
My contiri
pipol I nor know weda una go fit keep dis secret o, but I go tell una. God is wonderful o. Sebi una know sey Baba
tell me many things on how to start di business, Money dey o, I go do big table
wey I go put my papers, buy one big umbrella, do one chair wey I go taik dey
sidon.
Oh boy, wen I
sidon calculate all di money wey I go taik start ehn, di thing go chop reach
Fifty Thousand Naira. Tell me wia Oshobey go see dat kain money. All di friends
wey I get na… na I beg, maik I forget dat side. So, di thing surprise me well
well wey Mama Tobore sey im go give me all di money wey I need to taik start di
business of my Newspaper Vendor. Una just dey luk, una na nor fit helep me
shout seven Praise thy Lord and Seven Hallelujah! My pipol, God nor dey sleep
o. Di God wey do my own for me so go do your own for you too in Jesus name.
Maik una
helep me salute my wife and I promise am by di grace of God sey na dis my
Vendor business naim we go taik hama. Di next time you go see me na for my
Newspaper Vendor Stand wey dey for NTA Round About near Graphic Newspaper.
See you on
Wednesday

Comments
Post a Comment