DEN DEY TRETIN MY MAMA O! AG RECTOR
Nor be today I don dey tell di food vendor wey dey nia wia I dey do own Newspaper Vendor maik e dey try clean wia im dey sell before im go home every day.
I don talk sotey e kon be like sey my talk wan bring wahala with me and Mama Josephine. Evun John e senior Pikin wey I complain give to helep talk to im Mama maik e dey clean wia e dey sell Rice and Beans plus including Dodo join with swallow, e nor helep mata.
Every morning before I comot from Newspaper Depot, kon see how Okada riders, Keke rider, Meruwa plus including office workers go gada Mama Josephine dey hustle for food. Na so pure water leda go full everi wia go reach my own place. Me, I dey sell pure water? NO!
So, dat morning wey Environmental sanitation task force kon gbab Mama Josephine sey e dey dirty wia e dey sell, I nor talk bicus I don dey tell am since. Evun though sey as dem carri am go dem office dat day, di thing affect my bizness, I no worry sake of sey wen she return e go change.
True true as den carri my nebo Mama Josephine dat morning my market get coma o, I nor go lie at all. You see, as dem dey come chop dia na so den dey come read newspapers, although plenty of dem na free readers but some dey buy sha. Abi na di gossip I wan talk.
Dat day, na two work naim I do, One, I turn my nebo PA, bicus any person wey come chop go ask me, “Oga Vendor wey your nebo wey dey sell hia, ha! Mama Josephine no come today Oga Vendor? As I dey answer dem na so I dey attend to pipol wey wan buy Newspapers na so I dey shout “ Oga drop dat newspaper, na sell I dey sell am” I hia nwi dat day.
One tori wey catch the attention of nialy all Papermentarians dat day na di tori of Many days for di tiff one day for di owner. Hmmmm, na nialy all di Newspapers naim cary di tori. Oya hia dem head lamp oh sorry jare headlines.
News Express put am like dis, 12 Poly students arrested at exam ‘ magic centre ‘ Anoda one sey ‘ Rectors academic reforms reveals cans of worms’ ‘ Examination Magic Centre Busted ‘ We are expecting a fight back- Ag Rector, kogi Poly. The Herald Newspaper nack sey ‘ Examination Magic Centres, we will get their Sponsors soon’-Dr. Ogbo
Di headline wey maik many papermentarians carry papers pass na Naija Ofofo wey nack am sey ‘ Den dey tretin my Mama o- Ag Rector kogi Poly.
Shehu sey na right from di time wey di new Ag Rector enter office naim im know sey di Man go face strong wahala.
Onos sef talk sey im tell somebody sey di way wey den dey talk about di new kogi state poly rector so, Wahala go dey o. Na Ojochegbe naim kon ask di main question wey maik everi body eye open. Shegbe ask Onos wetin den sey Di Rector do wey go maik am get Wahala?
E sey, wen di Rector come, e call all staff and tell dem sey many things go change o and dat e come come turn things around o. As e begin dey tell dem wetin e want to do and wetin e no want to dey see, some pipol eye kon change.
As Onos dey yarn, na so many papermentarians begin dey shake dem head dey sey, ok we understand di tori now.
(TO BE CONTINUED)
Maik we see again on Saturday.
Follow di tori for Oshobeythespeaker.blogspot.com

Comments
Post a Comment