GBAJABIAMILA POLICE DON KILL NEWSPAPER VENDOR O

As I comot from bathroom dat early momo maik I softly wear my trouser and shirt begin dey go awa Newspaper Depot, come see my Wife tanda gbigbi for door mouth begin look me tititi.

I come comot my eye glass to comfam weda na my wife, Mama Tobore  naim stand for my front so, My pipol na im o. I know sey by di grace of God since wen I start dis Newspaper Vendor business, Baba God dey helep me dey meet up with wetin husband suppose dey do for im family. So, I  gada mind ask Mama Tobore sey wetin be di mata?

Na wen I see small smile for im face naim I know sey palava no dey. As I see dat smile comot from im face ehn, e remind me of wen we start back den for Ibusa, for Delta State. Maik dat tori be for anoda day.

Na so e hold me for hand, draw me sidon for chair, by dis time na 5:40 am. E sey wetin stop di prayer wey we dey do for morning before I dey rush go depot? I dey look am tititi, na so e carri  OUR DAILY MANNA wey we dey use for morning devotion, we sing, pray and study wetin dey dat dey before I go depot.

Dat day for my Newspaper stand, na so I begin dey think and dey tank Baba God as things don change level since I begin do dis business, evun some of my friends sef don confam sey den dey see God hand for my life.

As usual, for dat morning free readers don gada, di ting dey do me too like magic di way wey den taik dey gada sef. Na di tori of wetin CNN talk sey den go do Nigeria sake of di Soja kilikili for Lekki toll gate naim Papermentarians dey argue dat day. Idemudia wey be Mason sey maik CNN carri dem wayo go, e sey na so den do Donald Trump for America.

Abass wey dey ride Okada sey na wetin den dey expect since don dey come so. E sey im want maik many obodo yinbo contiri sanction Naija for wetin hapun for Lekki, e never talk finish naim Okoro my friend tell am to shut up. Okoro sey na wetin we get wey maik am tink sey we go fit survive sanction?

Di argument don begin dey hot dey go and I dey enjoy am naim my shinko phone ring, as I  taik my left hand cover di face to see who dey call, na awa Newspapers Vendors Association chairman. E sey police don shoot one of awa member o.

As I shout heeeeeey! E die? na so all my customer begin ask me wetin hapun. Oga Vendor wetin hapun? Who die? Wia e for hapun? Na your person? As I open mouth tell dem sey na awa Oga Vendo chairmo jus call me now to tell me sey one of awa member naim police wey dey escort Oga speaker Gbajabiamila shoot die.

Immediate immediate one Man wey dey always carri big phone wey be like book, im too na my regular customer don confirm di tori. E sey one online newspaper wey den call News Express don carry di tori since. Na so customer shift go im side as e begin read di tori loud like NTA Newscaster for dem from im phone.

Di tori of dis awa member wey die so jus scater my whole day and my market. But I begin tink of something, My brother, my contiri pipol nor taik your early momo prayer play o.

Maik we see on Wednesday.

Go oshobeythespeaker.blogspot.com to follow di tori

 

      

 

Comments