OGA RECTOR, YOU GET WORK O
E still dey wonder me di way wey my Nebo wife taik dey get im own tori. Sometime me wey be Oga Vendor dey koto for my nebo wife as e taik dey gada e tori. You dey laff?
Dat day as I close reach house from all di shout, quarrel, settlement of my free readers plus including insult wey I dey get from dem, na so I come meet my wife sidon with my Aproko nebo wife dey tori.
Mama Tobore, you hia wetin den sey hapun for Kogi Poly, Aproko woman dey ask my wife. Sebi you know sey I know dey sabi anything wey dey hapun for dis contiri. My wife sef reply am.
Nawa for you sef o. You wey ya husband na Newspaper vendor wey suppose dey hia news pass me na me go dey tell una wetin dey hapun. See, no kon yab me here, I know beg you for news o, na you by ya sef carri tori come meet me o. Na so my wife give am back. I begin laff.
E don do, na play I dey, but anyway, den sey if you see di plenty students wey den gbab for di school wey go write Exam for magic centre, fear go catch you. Aproko woman begin nack tori.
Di tori be sey di new Rector sey im don dey get report sey something like dat don dey hapun, but sake of sey e never get proper evidence, e nor fit come out kon talk di tori. But wen e kon set trap for di pipol, di trap kon catch dem. My sister kon see di plenty students wey den gbab. Oghene biko!
My wife kon talk sey na wia dis world dey go sef? See pikin wey den send go school maik our lecturers teach dem beta book plus including good character, naim dem wan spoil for ground. Na wen Mama Tobore talk dis word naim Aproko woman ask am why e dey talk like dat.
My wife kon sey im believe sey wetin dey go on for di Magic exam centres na wetin Lecturer go get hand inside. As my wife talk dat one, I shake my head for wia I sidon dey listen to di two Amebo dem tori.
Aproko Woman kon talk one thing wey maik me and my wife fear. Aproko Woman sey im hear sey na bicus den nor dey pay dem , (Lecturers) plus sey di Rector stop lecturers to sell Handout for students naim maik dem dey do dis small small shua shua. My wife kon shout sey you call dis kain ting small?
Nebo! Nebo!! Nebo!!!, how many times I call you? I beg maik you no let dem know sey na your mouth dem hia sey Fish don wear rain coat o.
Nawa for you sef o mama Tobore, no be me and you dey here? For wia I dey listen, I jus shake my head. I sey no wonder den sey di wall get ear. If den know sey I dey hear every thing.
My wife begin talk sey im go want maik di new Rector continue wit di work wey sey im wan do to comot all di yamayama wey dey maik di certificate of di Poly no get respect.
Aproko woman kon talk something wey maik me happy for for di first time. E sey as di Poly Rectoc come sey im wan clean di school, im wey be Rector too must ready to maik e hand clean sake of sey you no go fit comot small shikini wood from ya nebo eye wen Gedu dey your own eye.
As I hear dat word from im mouth, my belle turn sugar industry, na dia I sey hmmm, Dis Rector get real work to do.
See you on Saturday.
For more tori go oshobeythespeaker.blogspot.com

Comments
Post a Comment