TO BE A MAN, NOR EASY O
Since di day wey Oga Gbajabiamila security aide go kill one of our member, na so we members of di Newspapers Vendors Association of Nigeria don begin dey fight to see sey den maik sure sey den do something for di family of awa member.
Oh yes! na true sey everybody must to die one day but we no pray maik we die premature talk less of sey na one oga SSS wey body dey sweet naim go kon send Man Pikin go thy Kingdom come.
Wetin persin pikin no go see for dis contiri sef, na here Baba sey pipol pikin den lazy. Now, di one wey dey hustle with small Newspapers wey e dey sell, one trigger happy DSS go fall am.
As I carri my papers land my Newsstand di day after den kill dat awa member, kon see as Ppapermentarians begin yab awa Law enforcement agents. Onimisi sey e dey wonder if den dey teach dem how to handle guns for dem training school sef. Abi na katapot den tink sey den carri?
One Old Baba wey im name Tajudeen wey we dey call old soja sey for dem time, den no dey carri dey fire gun tatata. E sey if your bullet no correct after any assignment without sey you give beta answer, na guardroom be dat for you. But today, di tori difren.
Ojochegbe sey even One small boy wey jus get money fit carri police go im papa or im Mama burial. E go tell police to waste bullet to show sey im don arrive. Mufun sey di one wey dey pain am pass be sey some of dem go taik shayo, kparaga before den comot house and even for duty sef, some dey mayan.
As den jus dey tuk di mata dey go, my mind no jus dey dem mata at all, I jus dey tink of how to pay for my levy as den don finish emergency meeting to contribute Akpalakpala to taik helep di family for di burial.
Now, some pipol go dey tuk for dem mind sey Oga Vendor na stingy sey e no wan pay burial levy. No, nbano, nor be so. Why I nor go pay, what of if na me di thing hapun to nko? My pipol na di money palava.
Una dey see dis Newspaper vendor business, gain no too dey o, join with wetin awa free readers dey do here. Na shikiny gain dey dis paper bisness. Dat na why if dis kain wahala fall like dis, e be like sey na blood den dey sok from man body as i dey comot di money to pay di levy. Osa lo buawen
As we dey tuk dis mata now, sebi una sabi sey awa contiri don enter anoda economic recession again. Na wen we go free from all dis palava sef for dis contiri?
As i dey dey tink all dis mata, naim my shinko fone ring, as I carri am look who dey call, na awa Chairman. E sey den select me to be among dey pipol wey go follow awa late member dead body go im village for burial.
My pipol, to be a Man, complete di rest.
Maik we see on Wednesday o.
See more tori for Oshobeythespeaker.blogspot.com

Comments
Post a Comment