WETIN MAIK COMMISSIONER DEY CRY?
E don tey wey I don talk sey no amount of money wey Baba God taik Bless me for dis world go maik me forget my old friends. Tufiakwa! No be me.
Na sake of dis my Vow naim maik me tell some of my friends sey as I don start dis my Newspaper Vendor bisness so, maik dem sabi sey I nor go fit dey get chance dey come sidon with dem under Tree for opposite First Baptist church dey play draft as before.
I even tell dem di time wey den fit come see me for house if den no fit come my Newspaper Stand. The work na every day of di week but sake of sey I nor go fit taik Church play, I nor dey go my Newspaper stand on Sunday.
I maik sure sey after Church service, between 12 noon go reach 2pm na di time for me to sleep well well. But from 3pm tili 10pm na to visit friends or friends visit me. Sunday na my rest day for di work.
So, wen my wife kon tell me sey my friend Okoro dey palour dey wait for me for di time wey I taik suppose sleep, I be no wan come out, I even vex for my wife sey, sebi im don forget my Sunday time table?
See me see OKORO for my palour, I tell am sey if nor bicus sey awa friend don tey, I for no wake from my sleep o. Okoro kon open mouth tell me sey I don dey do big Man shakara sake of di small money wey I dey get from my newspaper bisness.
Okoro get bad mouth I know. So, i no answer am. Di one wey kon maik me vex na wen e kon tell me sey wetin I see talk for di mata of the Commissioner wey dey cry for Press interview. Na dia I vex open chapter for Okoro.
I tell Okoro sey if e nor get beta tori to talk, maik im waka comot my house. Okoro dey look me tititi like sey I be ghost. E no believe wetin im dey hia from my mouth. I tell am to come Newspaper Stand come talk im tori if e really wan talk about di mata.
Trust awa Journalist and Newspapers, nearly all dia tori carri Cmmissioner wey dey cry. One sey “ WHY THE COMMISSIONER WEPT” anoda one sey ” SAKA WEPT” . Dis Headline kpakpa remind me of the book of John 11:35.” IF ONLY THEY KNOW WHAT THEY HAVE DONE”, Na wetin anoda paper write. Kon see Headlines!
As usual Papermentarians dey on ground to talk dia own side of di mata, Ona Man wey sey im be retired Teacher sey na school wey most of awa pikin dem no go naim dey cus all dis ting. Shegbe sey na poverty naim cus am. Di retired teacher tell Shegbe sey na lie, e sey na book wey den no know naim cus am order wise dem for know sey Hospital equipment no be beans or Palliative.
One Okada rider kon nack proverb sey, if dem carry coffin pass your front house, if no be your relative dey inside, you go sey na firewood den carri, but if na your close persin dey inside, you go call am coffin. E sey na di Commissioner know di pain of wetin hapun naim maik am cry.
As e dey finish im talk, see Okoro dey waka dey come. I know sey ti tori wan tie wrapper be dat.
My pipol, We go continue on Saturday.

Comments
Post a Comment