WETIN MAIK COMMISSIONER DEY CRY

E no get any work for dis World wey no get im own hazard abi na risk you go call am. So dia for if you dey dia and you dey tink sey na di risk wey dey any work or bisness naim you dey luk before you go enter, you go tey for ground. In fact you go chop ya eye.

Dis my Newspaper vendor bisness get im own risk and hazard o. Oh, so you nor know, if I tell una how many times I don settle quarrel wey nialy wan turn fight una nor go believe me. As dem dey come dey carry my papers dey read, dey argue plus sey den no dey pay, na wetin I fit do? Free Readers Association Nigeria ( FRAN ) No sey na me tell you o.

Di other day, na so Okoro jus waka come tell dat retire teacher sey maik e go sidon one corner sey na Crocodile cry naim Commissioner dey cry. Okoro sey why e be sey den go put dat kain Ogbonge hospital equipment dia, wey plenty hospital dey groud wey den go use am.

As Okoro talk finish, di retire teacher fire am sey im nor surprise sey Okoro dey talk like dat bicus im know sey OKORO fit nor finish primary school. Kon see how other Papermentarians begin fall down dey laff Okoro.

Onovughe aka Onos my Niger Delta Broda nor join laff for di mata at all but e kon tell everi bodi wey dey laff sey why den nor allow Retire Teaher answer di question wey Okoro ask sey why den keep di plenty Ogbonge machines for container wen hospital dey wey den go put dem?

Di teacher wey be like sey naim be talk Man for di cry cry Commissioner kon talk sey dat kain special Machine nor be wetin den jus dey carri dey put for hospital, e sey den dey prepare special place wey den go put am and im see sey Gofment don dey prepare di place before den go scaka and spoil every ting for ground so.

Ojochegbe, sey for im , e nor sopot wetin dose pipol do at all, e sey as dem break enter dat place and den kon see sey na machine like dat dey dia, and na food den dey luk for, den for liv dat place and di machine for dia jejeje.

Mufun sey di one wey dey pain am be sey na di same big Oga dem wey we dey cry sey dem dey chop awa money na dem go still go buy anado machine with gofment money, awa own money! kon even chop on top wen we all dey cry sey money nor dey.

As retire Teacher hia wetin Mufun talk, e ask wetin Mufun go drink. One time e sey maik den bring one cold kunu for Mufun. E sey na only Mufun understand wetin awa big Men dey do for awa contiri.

As all dis mata dey go on, I see sey Okoro dey catch some sense from wetin Teacher dey talk.

From wia I sidon, I kon ask all di Papermentarians weda as dem dabaru di machine sake of sey den dey find palliative den go fit still use am treat pipol? Everi dodi answer NO, so dia fore who kon trowey im own? Na di Commissioner wey dey cry tabi na di common Man like me and you wey den go use di machine taik treat? Everi body know sey na obodo yinbo land den dey go treat dem sef o. I lie? Maik we get sense o.

Maik we do am again on Wednesday.

To follow di tori, waka go,  Oshobeythespeaker.blogspot.com

Comments