BABA GOD NO DEY LIE. OGA VENDOR CHRISTMAS DON SHELE O

Na jus last week naim my First Lady oh sorry my Best lady dey remind me of KIRESIMESI. Now, for dose of una wey dey wan know why I dey call my Wife Best lady, you see, I don find out sey First Lady dey expire, Yes! Some dia tenure na Eight, some sef na Three years while some no dey evun dey reach a year, fianm!  den do go. Thank God sey my no tribunal tabi na supreme court fit kon try nonsense with awa love long tenure. Na God o.

Yes, as I dey turk before, my Yawo sey maik I know forget sey as Christmas dey come so, she need to quick quick buy something put for House before the price of things for market go begin go up. I understand wetin my wife dey turk but my wife no understand sey dis my Newspaper Vendor bisness na Baba God dey helep me oder wise na shikiny gain naim dey inside o. Again, my life style before kon change and my Madam kon dey helep me as Financial controller. So dia for, Wahala no kon dey.

As dem teach us for Church, na so I just use faith taik tell my wife sey I hear wetin she turk and i know sey di God wey I dey serve go supply all awa need according to im Riches in  glory Phil 4: 19. Se una dey surprise sey Oga Vendor don sabi Bibeli like dis abi. Maik una dey dia, una go soon hia tori.

Wen I reach Newspaper Depot today, e kon be like sey every of my Newspaper Vendors na dem dia wife remind of dis Kiresimesi tori, as dem dey turk dia own dey complain of di contiri plus how coro kon maik tings wowo, na so I just dey pray for one corner sey Baba God na your hand I dey o. E no get wetin you no fit do o. Suddenly, no so I begin sing one song wey awa choir don turn to National Anthem.

Creator of di universe what can’t you do, what can’t you do Jesus. As I dey select my papers for Depot na so I dey sing di song. I sing am sotey I reach my Stand for NTA Round near Graphic Newspaper. As usual my pipol, PAPERMENTARIANS ( FREE READERS ASSOCIATION ) don tanda dey wait for me.

I never arrange my paper finish naim I see one tinted Hilux park for front of my stand. Evun all my free readers sef, fia catch dem but wen den kon wind down di glass, di person wey sidon for di back sit for Oga side kon call me . Wen I meet am, e tell me sey naim be di Hon. Commissioner for Information and Communication and im  want maik as from next year dey supply all Commissioners, Permanent Secretary plus including the State Library Three National Newspapers.

E sey im wan  see my proposal for im office before 1pm dat day but before im go, maik I give am Five difren National Newspapers. Na so jump go pack dem give am. Di commissioner open im bag give me Fifty Thousand Naira cash. E sey im don pay for advance for di supply wey im tell me so but maik I come with my proposal for im office for New State Secretariat. As I salute am finish, as I wan go, e call me back again and give me Five Thousand Naira, dis time e sey maik I taik am for my own Christmas package. Oghene biko o! Olorun Oba o!

As e drive go finish kon see as all my friends wey dey watch di Miracle Drama begin shout Oga vendor don hammer o, Oga vendor wey awa own, Oga vendor Baba God don butter your bread for dis Christmas o. E jus be like sey I dey dream. God no dey lie. Notin wey e no fit do.

Maik we see again on Saturday,

Visit oshobeythespeaker.blogspot.com for more tori


 

  

 

Comments