DIS BOKO KILIKILI DON TOO MUCH O

Na true sey if you nor plan early for any thing wey you wan to do, den you dey plan to fail  be dat . Na sake of dis naim maik me call my wife, Mama Tobore maik e come so dat we go quick quick plan how we go taik buy full bag of Rice and shia for nebos and  fellow Newspaper Vendors.

Wen my wife tell me how much rice dey cost now for market, na dia I tell am kpom kuem sey, Madam, I know tell you sey na foreign Rice I wan buy shia for pipol o. she jus laff and tell me sey na local rice price im give me so. E sey if I tink e dey lie, maik I go ask my sef. Na dia I know sey tori don wowo.

As I reach Newspaper Depot dat morning to carri paper go my Newspaper Stand wey dey for NTA Round about, kon see as pipol tanda dia dey wait to buy papers. Na dia I ask Yunusa my colleague wetin maik pipol plenty for depot like dis? Naim mouth I for first kon hia of di kilikili of Rice farmers for Borno State.

Kon see as plenti pipol plus including free readers ( PAPERMENTARIANS ) berekete dey wait for dat day papers. Na Shehu naim first fire me dat morning. Oga Vendor, why I dey tey today to bring favers fa.  I know hia wetin hafun for Zabarmari village for Jere local gofment Area  for Borno state?

Na later I kon know sey most of my customers plus including some free Readers dey listen to NTA or oda Television station dem news before den go kon my stand di next morning. Contiri pipol, tiredness nor dey fit maik me look TV after I don chop night food finish sometime around to 7pm or after 8pm.

Onimisi shout sey wich kain contiri we dey sef, Rice farmers naim BOKO HARAM still dey kill again? Shehu kon tell am sey, na di reason wey rice dey cost now. Shehu sey for some time now, farmer nor dey gree go farm sake of fear. Na dia my ear stand like oyinbo rabit. I remember wetin my wife talk.

Okoro naim nialy wan cus wahala dat day wen e begin sing one song dey call Biafra inside. Oniovosa my broad from Niger Delta naim first answer am.” Okoro, you get sense at all, wetin be di meaning of di song wey you dey sing now wen den sey 43 rice farmers die! You be Mumu o.” As if sey other papermentarians dey wait for who go first open chapter for Okoro, kon sey how den begin yab Okoro.

Okoro sef jus softly softly pick one paper evun wen I dey tell am to put my paper for ground, e go one corner begin read di tori dia. But for wia I stand, I begin reason di whole tori. Wetin jus dey for my mind be sey, so awa sojas know go fit do any thing to fit stop dis BOKO BOYS KILIKILI ?

Maik we see on Saturday

See more tori for oshobeythespeaker.blogspot.com

Comments