ENDSARS AGAIN ? I GO CUT ROPE O FOLLOW UNA- BUHARI
Before before wen I dey hear dat song wey den for sey strength of a woman, na so I go dey reason wetin di persin wey sing di song see sotey e sey woman get strength. Abi na bicus woman naim maik Strong Samson die, Abi na how den do King Solomon abi na di Apple tori for Bible or na di one wey den sey hapun for awa Obodo Naija.
I dey still dey wonder why den sey Woman get power untili di today wey I wake for early momo as I dey do before. After I wake up baf finish, I call Mama Tobore maik e wake up for morning Devotion before I enter road dey go Newspaper Depot.
Na after di morning devotion naim my wife start to tell me sey if I love am maik I no go work dat day. Ogheneme Biko o! Wetin hapun na, my wife kon ask me sey sebi I see di Endsars protest wey start yesterday and I hear di kain word wey comot from Baba Buhari Mouth? I tell my wife sey no be im go dey tell me wetin I go tell am, I be Newspaper Vendor, I sey I know. Na for dia e kon sey if I sey I know, why I wan go enter inside danger! E sey lai lai to lai lai I no move sam sam.
My contiri pipol, e taik nebos to kon beg my wife before e fit left me go Newspaper depot dat day o. But who go blame my wife, if you witness how di jejeje Endsars protest taik turn to gbeghe, Kasala, tifitifi, plus including Kilikili who go allow im dear husband enter town sey na vendor work naim e dey go do.
Dat day if den sey I late go Newspaper Depot na anoda word wey pass late den go call am. But as a wise Warri man, I call Depot maik dem keep papers for me. As I land my Vendor stand dat day, kon see crowd of Papermentarians dey wait. Di good once dey ask wetin hapun why I late to bring papers, di bad mouth dem dey sey I don to get money naim maik me dey do shakara now.
One word I no answer dem as I dey arrange my papers. Na one Oga wey every body dey call Endsars naim first start mata dat day, Endsars sey wetin den go do dis time go bad gan. Before e finish talk, kon see how one OKADA rider wey den dey call Sunday enter am, Sunday sey im no dey sopot dis second Ensars bicus e find out sey all wetin den talk sey dem want maik den do, Gofment don dey doam, so why den dey still dey protest.
One retire principal wey be my regular customer kon sey maik Sunday go collect food from my nebo wey dey sell Rice and Swallow. Retired principal sey if Okada rider go fit reason talk dat word den we get hope for dis contiri. Na dia Sunday kon tell retire Principal sey im na National Diploma (ND) holder o, e sey na work wey no dey naim maik am dey do Okada work o.
One Man wey no dey too come my vendor stand kon talk sey if den fit change di protest name from #Endsars to #Endbadgofment, im go like am. Haruna sey if dis Ensars pipol fit just carri waka go National Assembly go forward match all di big Oga dem from dat place enh, im go dey happy well well.
Na wetin Haruna talk last naim maik every body for Papermentarian kon sey yes na wetin remain wey dis Ensars pipol go do for dis contiri. Oga Endsars wey dey wan corner dey listen to dia tori since kon open mouth like as Fela talk kon begin yab dem sey den go dey Newspaper stand dey yarn Opata but wen den sey maik den go join protest, no body go wan join. E sey who dem tink sey be dem fool wey fit to die for dem?
Maik we meet again on Saturday
Visit oshobeythespeaker.blogspot.com

Comments
Post a Comment