WELCOME 2021, MY LEVU DON CHANGE O

Hmmmm nor be small ting o. So na me and you dey like dis  gidigba dey look 2021 calendar kikiki with awa two nakedness eyes so! Baba God we tank you o, if not be Baba God ehn, Wetin 2020 plan enh, no be here o!

Oya maik we check am, first na corona virus, we never comot from dat one palava, see flood everi wia, before we sey jack, see #Endsars, before you ask wetin dey hapun kon see di proper palava wey be Palliative! Na my mouth una wan hear sey fish wear rain coat abi, for all dis one wey dey hapun so, na so human being dey delete dey go thy kingdom come. Hmmmm,  no be small ting sha, we tank God sey me and you fit still see 2021 wit Kakaraka body.

Me, Oga vendor, I go tank baba God well well for dis Keresimesi wey pass so o, infact, I no go lie, na dis one be di first time wey I don enjoy my keresimesi since wen I sabi my sef as Man.

Una go remember di tori of the Honorable wey come my Newspaper stand with Hilux, yes, na dat very day my joliment for my keresimesi start. After di commissioner give me part of di money wey I go taik dey supply for di state, na so e give me 5k maik I taik hold my sef for di Xmas jolimento.

Later dat day as e turk sey maik I bring my proposal come im office, and as e be sey I never write proposal before and I nor know how den dey do dis kain proposal, na so I sofly sofly go me Baba old vendor from Lagos. Maik God bless Baba o.

My pipol, experience good o, as I explain give Baba old Vendor how commissioner for information and communications come my Vendor Stand come tell me sey as from 2021 na me go dey supply all gofment office, baba shake im head kon tell me sey my days of hand to mouth chop chop don pass. I sey Amen.

By di time wey baba finish di proposal, na dia I know sey you nor go fit taik persin experience from am evun if you drive di persin from work. True true, Baba old vendor sabi di work.

As I enter di new state secretariat wey commissioner office dey, kon see as my customers wey sabi me for my newspaper stand dey hail me like sey I be Baba for Aso Rock. As I tell dem sey na commissioner for informate naim I kon see, na me kon dey choose who wan carri me go im office. Everi body naim wan carri me go dia but I kon use sense ask dem sey wia be im office? Den tell me sey na di top top floor. Na so I trace am go.

As commissioner see me, e shake head give me im hand shake den ask for di proposal. As e dey read am e dey smile, na wen e finish e kon ask me di question wey go maik me wan go evening school now. E sey maik I talk true sey na me write di proposal? As den don teach us for church sey nothing like small lie, sey lie na lie, I kukuma tell sey na one old retired vendor write am for me.

Again, commissioner look me shake head kon sey maik I know worry maik I drop my account number with im secretary as I dey comot im office. E sey im like wetin e see for my proposal and maik I nor fail to dey supply all di pipol wey im tell me sey maik I dey supply. E sey maik i nor play wayo sake of sey den go dey taik record of wetin I dey supply o. I tell am ok no wahala.

As I dey comot im office, e give me Ten thousand Naira and tell one of im boy maik dem give me 10kg bag of rice.

Na so I taik tell my sef sey dis keresimesi I must go village go doam. I go village with my wife, Tobore later comot from school kon join us for village. We flez village last year no be small ting. Money dey and as God don change my level, I pay all my family meeting money and evun host friends. You wan try Oshobey.

I don come back to base. Bizness don start but as e be with my standby supply, my level don change o.

Welcome to my Turnaround Era, 2021

Maik we see again on Saturday.

Go oshobeythespeaker.blogspot.com for more tori

   

 

Comments

Post a Comment