MUFUN WAN PUT ME FOR POLICE WAHALA O
I don tuk am
befor sey dis 2021 na di year wey I go taik serious decision concerning dis my
vendor work. I don tuk sey any of my friend wey nor dey helep me, wey bukuru
pipol sabi as Helpful relationship, I go comot am from body.
Evun some
Papermentarians ( Free Readers ) wey I don dey notice sey dia own na to kon cus
palava for my stand, one time, I go give you sound warning bikus you know go
fit kon use your reagea taik kon spoil my Blues.
My contiri
pipol, see me wey dey manage my sef for my small Newspaper stand here naim some
pipol wan kon bring wahala kon give o. Una sabi sey argument nor be quarrel,
but wen two Men wey dey prepare to be grandpapa go argue sotey go begin set
blow to fight, dat one don turn disgrace.
Na dis week
wey pass so naim dis North Traders sey den dey go strike sake of sey den dey
too dey kilikili dem traders members for South of di contiri so dia for den no
go carry food kon south again.
Garuba wey
be chairman of iron condem sey na correct, “ Haba dem own too much mana, Na
efribudy be Fulani, jus dey kili fivo anyhow sey na herdsmen, haba mana, maik
we stop am for food to come di south, especially Yoruba fivol”
As Garuba
dey tuk im own dey go with my newspaper wey e never pay for for im hand, i
begin sense sey wahala go bust. I never tuk finish for my mind naim Mufun sey “
Garuba, na today I know sey na Malu brain you get, as you fit dey comot dat
kain yeye word from your mouth”
Before I go
sey hey! Garuba drop im paper for table,
jack Mufun for im shirt. Mufun sef hold Garuba shirt. As dem wan begin start
dem own Royal Rumble for my Newspaper stand naim oda PAPERMENTARIANS join hand
dey separate dem.
From no wia
see me see Ekelebe, Olokpa! for my
stand. Dem call me go corner kon dey warn me sey den don find out sey I dey
allow hate speech well well for my news stand and dat dem don dey maik sure sey
most of all di Popular Newsstand for town like my own, den go dey send olokpa
wey no wear uniform come dey join us dey read newspapers.
Immediate
shap shap, den don carry Garuba and Mufun go dem station. Na dia I kon dey tell
di oda Papermentarians wey begin ask sey how Olokpa taik show fiam without sey
den call dem. I let dem know sey as dem dey hia dey read Newspapers free free
so, Olokpa dey amoung dem o.
Oya contiri
pipol, na my palava again to hold pipol maik dem no talk as dem dey read tori
for Newspaper, sebi dem sey freedom of tuk abi how dem call am sef. Nor be
wahala den don dey carri come my market so!
Sebi as
Garuba tuk im own, Mufun too for tuk im own den odas go chuk mouth for di mata
begin dey argue am as we dey doam here befor but Mufun go sey Garuba get Malu
brain. Una don see how Mufun wan cus Yawa for me .
Maik we see
on Tuesday.

Comments
Post a Comment