NDLEA DON CUT ROPE FOLLOW IGBO SMOKERS PLUS INCLUDING DRUG TRAFFICKERS O.

 

I nor know now if na beta ting I do wen I gree sey maik my wife, Mama Tobore taik dat small shop wey dey  corner of awa house dey do im market o. Una sabi my tori, Mama Tobore play very gud role for dis Vendor bizness wey I dey do today so. And for sake of dat naim we reason sey maik e come near house begin sell some food stuff like Rice, Beans, Garri, Yam, Plantain, Obgono, Egusu, Pepper and othe orishirishi. In fact we call am MAMA TOBORE BUSH MARKET.

My contiri pipol, di only ting wey I kon dey see for di whole tori now be sey, my wife don turn Area Reporter, I mean Aproko for me wen I come back home from my Vendor bizness. After all di stress wey Papermentarians( Free Readers ) dey give me for my Vendor Stand, If I reach house wen I tink sey I go baff, sidon chop, listen to news and sleep, na dat time my wife go wan tell me everiting  wey  hapun for area. Haba!

Yesterday tori get as e be sha, evun dough sey I  tire wen she dey tell me, I dey taik style dey sleep and style lisen bicus na tori wey many of awa Papermentarians don dey tuk for sometime now for stand. Na one boy wey dey awa area, maik i nor call im name. Na im tori Area Reporter carri put for ground for me. I beg, maik una no let my wife hi dis Area Reporter o. If wahala bust una no go get area report again o. Enhen, as I dey turk before,

 Di boy na persin wey den dey wear fine cap and im dey bend im head. Im Papa  na director for one Ministry for state and im Mama na Teacher. Im two seniors wey be boy and girl don finish University. One don dey work beta work with gud salary, di oda one wey be di girl  still dey find work but dia junior broad sey na jaguda, Agbero work im wan do. No be sey den no redy to train am o. Den tell am to learn work, wusai! E no gree learn. Bukuru pipol sey na Black Sheep.

As i dey nack una dis tori, di boy don enter NATIONAL DRUG LAW ENFORCEMENT AGENCY ( NDLEA ) Palava. Di tori be sey di boy go open wan small joint wey im dey sell KPAKPA, I mean IGBO, Canabis. Tori kon worwor for di boy wen somebody for di area sey im see something, naim e sey im go sey something. Na wetin e sey give NDLEA  naim maik awa guy don dey enjoy free accommodation for NDLEA office so. My wife sey,wen di NDLEA officers wey raid di joint kon gbab di boy and some of im customers, dem drop message wen den den dey go sey den ready for igbo smokers and drug traffickers. Den sey no place for dem to hide again.

We go continue di tori .  

Maik we meet on Wednesday

Comments