OGA BUBA MARWA GET WETIN E DEY DO.

You see dis our vendor work enh, e get di wey e be, if you nor taik time na so you go maik plenty enemies. Some body go waik up sey maik e go find wetin im go taik feed im family, e go come jam pipol wey dey talk contiri mata for in stand, kon evun taik am fight.Wahala!

Dis vendor work  be like fish wey dey water and you kon dey argue sey im body nor go wet. Lai lai! Na big lie you talk. Na di same ting e be if you sey you nor go talk pim if you sidon for your vendor stand.

Na either you dey shout for dat papermentarian ( Free reader ) to drop yur paper wey im don carry for more dan 30 minutes and e nor wan buy am or you dey settle hash argument wey fit turn to fight . Oghene me biko o, vendor work no easy o.

Today, na so I display my papers as usual. I sey maik I go collect Fifty Naira Akamu with Hundred naira Akara from di woman wey dey nia me, before I come back na hot argument of NDLEA Oga naim my pipol settle with o.

Okoro read for one newspaper sey operative of NDLEA don gbab wan  woman wey dey go Italy with 100 wraps of heroin. Na so okoro begin dey praise di NDLEA Pipol, Okoro sey since di new Oga for NDLEA enter dat office, na so im boys just dey gbab dis pipol wey dey carry drugs.

Niger Delta boy, Onovughe sey na arrange tings be dat, e sey im too don don dey read how no week go pass wey dis NDLEA boys nor go catch pipol or pesin. E dey hold ground sey na plan work, but before im finish, Mufun answer am sey na lie, Mufun sey im beliv sey na di plan wey di new NDLEA Oga put for ground naim dey helep am.

One old man wey we all dey call old journalist dey one corner dey listen to di argument since, naim kon come and as usual begin nack big big grammar sey e get wetin den dey call incentives for work. Shehu kon laff di Oga sey wetin concern insect killer wey im dey sell with dis mata?

The old journalist we im friends dey call veteran  plus everybody wey dey my Vendor stand wan laff die. Na dia di old journalist begin tell our Papermentarians sey why den dey see magic for NDLEA now na sake of sey  one Ogbonge no nonsense man wey den dey call Brig Gen Buba Marwa rtd naim dey dia now as dem new Oga.

As papermentarians hia BUBA MARWA, Na so all of dem like sey den remote dem mouth, ask weda na de same Marwa wey be Gofnor for Lagos state before? Old journalist kon answer yes. na so all of dem chorus NO WONDER!

 

We go continue di tori on Wednesday.

Una dou oooo,I trowey salute.

 

Comments