BABA GOD DON
FIND WORK FOR ME O.
One shikiny
sleep no enter my eye dat night. Na so I carri face plus eyes face ceiling dey
tink life. My wife just dey one corner of bed dey sleep im own dey go. She nor
know sey na di word wey im tell me after im serve me food finish naim pusue
sleep from my eyes o. Maik I liv wetin she talk for now, bicus if I rimemba am
na anoda tori.
Day don
finali break and na sharp sharp I wia my shokoto comot for house go meet my
friends as usual for under di Tree opposite First Baptist Church dey play
draft. Na only Mufun fit call me go one corner ask me why my face no carri
smile like as im know me. Shehu, Okoro, chegbe nor just ask wetin I carri even
dou sey nor be dem dey play draft. I taik style wan dodge di mata but mufun wey
know how I dey always dey jolly jolly wen I come under di Tree sabi sey
something no correct.
I still dey dey tell mufun how my wife, Mama
Tobore yab me after im put food for table for me wen I hear from my back ‘Good
morning sirs, God bless you and Jesus loves you’ before I go answer am back,
see the small girl wey my pikin Tobore go taik about five years senior don give
me one small paper for my hand wey den write sey ‘ Come and see, JESUS CHANGES
STORY HERE! @ Living Faith Church, Phase 1 lokongoma lokoja. The small girl
smile again kon tell me sey if I honour God come church dat Sunday, God go
change my tori. Before I sey tank you, e don tell me maik I give am my phone
number, e kon be like sey she remote me, na so I give am and I kon again promise am sey I go come
church. I collect her number too. As all dis one dey hapun, na so Mufun just
tanda like image dey look me and di small girl o. Na afta di girl waka go
finish naim Mufun kon talk sey na God send di girl come and im want maik I no
miss di church on Sunday.
I dey church
wey di small girl invite me and na so I just dey look like sey I never go
church before. But di truth be sey den fit count how many time I don go church
since January go reach September wey di small girl meet me and Mufun dat day.
Inside church, Pastor preach, pray for pipol but one thing wey di pastor talk
wey touch me dat day be sey, e sey somebody dey dis church today, you don tire
for life but God don change you story today. Befor you live dis church today,
just ask God to tell you wetin you go do as bisness. I know sey I need bisness
to do but which one to do, naim be di problem, but I obey, I kon ask Baba God
as the Pastor talk, na so I hear one small voice sey Newspaper vendor. I open
my eye look round, I dey see piopl dey pray, pastor too dey pray, again I close
my eye maik I pray and wetin I dey hear na di same NEWSPAPER VENDOR.
My tori
continue
Welcome to
OGA Vendor.

Oga weldone, good story
ReplyDeleteThank you my beta persin. Tuale for you.
Delete