BABA GOD DON FIND WORK FOR ME O.

One shikiny sleep no enter my eye dat night. Na so I carri face plus eyes face ceiling dey tink life. My wife just dey one corner of bed dey sleep im own dey go. She nor know sey na di word wey im tell me after im serve me food finish naim pusue sleep from my eyes o. Maik I liv wetin she talk for now, bicus if I rimemba am na anoda tori.

Day don finali break and na sharp sharp I wia my shokoto comot for house go meet my friends as usual for under di Tree opposite First Baptist Church dey play draft. Na only Mufun fit call me go one corner ask me why my face no carri smile like as im know me. Shehu, Okoro, chegbe nor just ask wetin I carri even dou sey nor be dem dey play draft. I taik style wan dodge di mata but mufun wey know how I dey always dey jolly jolly wen I come under di Tree sabi sey something no correct.

 I still dey dey tell mufun how my wife, Mama Tobore yab me after im put food for table for me wen I hear from my back ‘Good morning sirs, God bless you and Jesus loves you’ before I go answer am back, see the small girl wey my pikin Tobore go taik about five years senior don give me one small paper for my hand wey den write sey ‘ Come and see, JESUS CHANGES STORY HERE! @ Living Faith Church, Phase 1 lokongoma lokoja. The small girl smile again kon tell me sey if I honour God come church dat Sunday, God go change my tori. Before I sey tank you, e don tell me maik I give am my phone number, e kon be like sey she remote me, na so I give  am and I kon again promise am sey I go come church. I collect her number too. As all dis one dey hapun, na so Mufun just tanda like image dey look me and di small girl o. Na afta di girl waka go finish naim Mufun kon talk sey na God send di girl come and im want maik I no miss di church on Sunday.

I dey church wey di small girl invite me and na so I just dey look like sey I never go church before. But di truth be sey den fit count how many time I don go church since January go reach September wey di small girl meet me and Mufun dat day. Inside church, Pastor preach, pray for pipol but one thing wey di pastor talk wey touch me dat day be sey, e sey somebody dey dis church today, you don tire for life but God don change you story today. Befor you live dis church today, just ask God to tell you wetin you go do as bisness. I know sey I need bisness to do but which one to do, naim be di problem, but I obey, I kon ask Baba God as the Pastor talk, na so I hear one small voice sey Newspaper vendor. I open my eye look round, I dey see piopl dey pray, pastor too dey pray, again I close my eye maik I pray and wetin I dey hear na di same NEWSPAPER VENDOR.

My tori continue

Welcome to OGA Vendor.

Comments

Post a Comment